LyricFind Logo
LyricFind Logo
Profile image icon
Lyric cover art

GOD WHY

Apple Music logo
Deezer logo
Spotify logo
Lyrics
I don dey here since midnight
Just me and this ceiling
I don talk to You tire
But the silence still dey
I no vex with You
I just.. I just dey confused
Cause the people wey I love
Dey go through things I no fit fix
And I want to be strong
I want to say I trust You
But God.. tonight e hard
E really hard
But I no fit leave You
Where I go go
You get the words of life
Even when I no understand Yours
Morning dey come
I know morning dey come
Even though right now
All I see na night
I don count the days wey I don wait
I don count the prayers wey feel like dem never reach
I don smile for people face
When inside me dey scattered
I no wan pretend with You tonight
You know everything anyway
So here I am
With nothing to show You
Just.. just this
God
I don tire
I really don tire
But I still dey here
I still dey here
Because.. because You dey here too
You been dey here
Even when I no feel You
You never leave
So I no go leave You
Even if e pain me
Even if the night long
Even if I cry reach morning
Because You be God
Through everything wey happen
And morning dey come
I know.. morning dey come
Thank You for staying
Even when I forgot You were there
E don do

WRITERS

OLADIPO O-FRESH

PUBLISHERS

Lyrics © O/B/O DistroKid

Share icon and text

Share


See A Problem With Something?

Lyrics

Other

LyricIQ Analysis

Top Emotion

Enjoyment

Sentiment
Thumbsup IconThumbsup Icon
Theme

Religion