LyricFind Logo
LyricFind Logo
Profile image icon
Lyric cover art

No Wahala

Apple Music logo
Deezer logo
Spotify logo
Lyrics
Ahh
How far
Love season don land again
Abeg, hear word o
Scroll, scroll, see feed full with fine fine love
Dem dey post, dem dey pose, you dey wonder am I a spoon
Calendar dey shout Valentine, your chest dey beat
Single pringle dey wonder when e go be my turn
Abi
But I dey tell you slow down, slow down your mind
Wahala no dey, your patience go pay off
Love no be race, no be by force something
If na real love, e go find you in due course
No dey rush, no dey panic
Love go come when your time reach
Maintain your steeze, maintain your composure
Make your heart fit dance to the right melody
No wahala, no pressure
Love go find you, your own never spoil
Maintain your composure
If na real love, e go land proper
No wahala, no pressure
Partner or single, you dey alright
To those wey get person but your heart don dey worry
You dey count last year, compare, you dey stress
Abeg hear me Love no be showroom
Na the small small kindness wey deep for your soul
You no get plenty gift, no mean say love no dey
The man dey try
No pressure am
Him dey put in work, every day, little by little
Someday everything wey you dey pray for you go get am
Singles, no dey vex
Your time go come
Give God time
No wahala, no pressure
Love go find you, e no go spoil
Maintain your composure
If na real love, e go land proper
No wahala, no pressure
Partner or single, you dey alright

WRITERS

Ogheneyole Oghenejabor

PUBLISHERS

Lyrics © O/B/O DistroKid

Share icon and text

Share


See A Problem With Something?

Lyrics

Other

LyricIQ Analysis

Top Emotion

Enjoyment

Sentiment
Thumbsup IconThumbsup Icon
Theme

Religion