We fast come, stomach empty
We fast come, stomach empty
Dem share us for houses láìṣe àní àní
Owena, Osun, Niger, Benue, Alani
We no plan am, but destiny join our hands ni
Brothers and sisters as one
Soak garri with kuli kuli,
Same bowl, same spoon, la base, la base
Code 96, 30 years don waka pass like play like play
East to West, North to South, our bond hold fast.
Wey bucket? We need water, ONE BOY
This roll call who no present, mount bunk
For unresolved beef after 30 years,
We fast come, stomach empty
We fast come, stomach empty
Wetin we no get, who we never be?
Success na the plan, successful plan B
In every sphere of life, you must see one of us
Some of us na investors, some of us doctors
some professors, some politicians
Bankers dey inside, business people dey
Engineers, lawyers, Musicians sef dey
Some still dey wear uniform, uniform men
Like custom, immigration, policemen
Even fayaman, that one na shiaman
To marry second wife na some people job
Those wey turn Pastor, turn Imam
Make Una elp us thank God
Say we count 30 and still counting
We fast come, stomach empty
We fast come, stomach empty