Cutie baby, I wan see you
Time to talk to you is due
You enter this party like whirlwind
This your beauty dey burst my brain
Every man just dey look you o
Dem wan familiarize with you
Afunkie na the real sexy baby
Funky skin care boss lady
Baba God done do am for you
Haters don cry tire for zoo
Just dey move with class and grace o
Cause you dey go higher place o
Now why them open mouth dey wonder
Wey dem when things dey under
When you dey look up to God
All your prayer was not in vain
Growing up with all that pain
Messiah come see your heart o
Come bless you with skin-art o
Come dance, begin dey praise God
No mind all those yeah-yeah fraud
Every man wan dance with you o
Dem dey look for romance o
Your voice sounding like angel o
Twisting waist like door knob o
Wave and smile like you no send them o
With God na higher you dey go
Them never see anything at all
God wey don bless the work finish
Na now dem wan remember you
If them like make them do anyhow
We go show say God pass them
The God wey dey answer by fire
Na Him dey control your life now o
You don carry cup, don win long time
Days of crying for you don finish
You apple of God's eye as promised
Make them scatter, find another victim
You don pass them by fire by force
Funke my love o (my love o)
Every man wan dance with you o (dance with you o)
Twisting waist like door knob o
Wave and smile like you no send them o
Every man wan dance with you o
Dem dey look for romance o
Your voice sounding like angel o
Cutie baby, I wan see you
You enter this party like whirlwind
Now you dey on God's mission
To dominate this location o
With celebration and jubilation
Twisting waist like door knob o
Wave and smile like you no send them o